Na Beans

 Mehko look Kendo, dat one look am back.



"Abobbi! Wetin dey sup nau?"
"Omo, street no dey smile o!"
"Na wa! Even you wey your shoe don shine?"
"Guy, na wash. My shoe shine I follow you Sosiddon here?"
"But your men dem..."
"Na all manchi for hinsef. Notin free for Freetown."
"Dat na true sha...So, how e go be?"
" Adey reason am. E be like we go block senior man."
"Atink? Make hin show us love."
"Na so."
"But eh, abobbi, parole gats level. Area just rough anyhow."
"Na time. Tings go pure."
"E go soft."
"Na beans we dey cook, no be stone."
"E go done."

As guy men dey stand up, one green Toyota Pencil light block them. Po-Po.

De oga of the Police point de moto boot,
"Make una enter, we dey go station."

Photo credit: shutterstock.com
Share:

Post a Comment

Copyright © John Chidi. Designed by OddThemes